Connect with us

World

International students in Canada dey seek asylum – why? – BBC News Pidgin

Published

on

International students in Canada dey seek asylum – why?  – BBC News Pidgin

Wia dis foto come from, Getty Images

Foreign students for Canada don dey contribute to di high number of asylum seekers in di kontri.

More immigrants don dey seek asylum and rely on public services to finance demselves through university education becos dem no wan go back dia kontri and dem no get any oda reason to remain for Canada.

While, e appear as an abuse to di system wey di Candian goment put in place to help pipo in dire need for aslyum, some foreign students fit dey stranded in Canada becos of some of dis reasons.

Increase in global conflict: Tension and wars for some kontris like Congo, Haiti, Syria and Ukraine don make more pipo seek aslyum as di global conflict no fit guaranty pipo dia safety wen dem return go dia home kontri.

Residency: Transitioning from Temporary Resident (TR) to Permanent Resident (PR) status in Canada fit dey difficult for some students wey no get sponsorship.

Work permit: If you wan work for Canada, you go need work experience in di kontri to work in your preferred sector, dis na one criteria wey some foreign students no get and dem still no get money to travel go back dia kontri.

Rising cost of living and housing: Increase in asylum seekers fit be becos of cost of living. Some foreign students no fit pay dia tuition and di cost of living don high forcing dem to drop out of school without school permit. Also, prices of housing don dey on di high side pushing new immigrants to seek aslyum afta dem spend on basic essentials like food, clothing, communication, transportation, among odas.

Foreign students for abroad

Wia dis foto come from, Getty Images

How Canadian goment intend to stop students from abusing dia aslyum system

Canadian goment don intend to strengthen dia study permit system by cutting am down by 35% in 2024

Immigration, Refugees and Citizenship Canada also annouce say dem go reduce di number of temporary residents from 6.5% to 5% by 2026

In January, Canada increase di cost-of-living requirement for study permit applicants to reflect true cost of living in Canada and help prevent student vulnerability and exploitation.

Graduates from programs from public colleges go dey eligible for Post-Graduation Work Permit (PGWP) of up to three years if dem graduate from field wey get shortage of employers.

Also, helping students get Canadian work experience na anoda means to help international wey wan remain in Canada to work, so dem go fit secure employment and get dia work permit.

E dey important make di Canadian goment address foreign students on di misconception of study permit and work permit, while dem encourage transparency in di system

Continue Reading